“Den di king go do wetin e like. E go dey make mout and karry body up sey, ‘I get pawa pass any oda god. I even high pass God wey dey heaven.’ E go dey susid until di time wey God won ponish am, don rish. God go do wetin E don plan.
Wetin dem like pass, na to sleep with who dem nor marry; dem nor dey taya to sin and dem dey draw doz wey dia faith nor strong, follow body. Dem don train dia mind to get long-trot and God don curse dem.
Afta dem don free from sin thru awa Oga God and Savior Jesus Christ and dem kon let sin masta dem again, dia kondishon for di end, go worse pass as e bi before.
So, my friends, as una don know wetin go happen, make una shine una eye, so dat una nor go miss di way and fall from di trut wey una get, bikos na so pipol wey nor sirious, dey do.
Dem bi like wave for sea wey dey foam kom out. Dem bi like star wey nor dey stay one place and God don keep di place wey deep pass for darkness, dey wait dem.