12 But dis men bi like animal wey nor dey tink; animals wey pipol fit kill anyhow and dem just dey do as dem like. Dis pipol dey tok anyhow and na distroshon go end dia life.
But I still sey, “Dat na bikos awa leaders nor get sense. Dem nor gri go meet God make E tell dem wetin dem go do. So dem kon do tins like fools and all di pipol wey dem dey lead, don skata finish.
But my God, Yu know mi! Yu dey si evritin wey I dey do and how I love Yu rish. Make Yu take dis wiked pipol komot like sheep wey dem won go kill. Tell us wen dem go die.
But God sey, “My pipol foolish well-well, dem nor know mi at-all. Dem bi shidren wey nor get sense and dem nor dey kwik undastand anytin. Na only bad-bad tins dem sabi do.”
So I kon sey, “Na only poor and foolish pipol dey bihave like dis. Dem dey bihave like fools, bikos dem nor know wetin God wont. Dem nor know wetin dia God wont make dem do.
to sleep with anoda pesin husband or wife, long-trot, evil tins, to deceive pesin, to dey misbihave, jealousy, to spoil anoda pesin, to karry body up and to do foolish tins, na from inside pesin heart all dis bad-bad tins dey from kom.
Even doh dis fake tishas dey promise dis pipol sey, dem go dey free, di fake tisha na slave dem bi to sin. Bikos pesin na slave to anytin wey masta am.
But dis pipol nor undastand wetin dem dey tok and dis na wetin dem suppose to undastand without sey pesin tish dem. As animals nor dey tink before dem do tins, na so dis pipol dey bihave.