Den e go look am again, if di diziz neva shange kolour, even if e nor spread e go still dey unklean; den una must burn di klot, weda di stain dey for back or front.
As Jesus look am, e kon feel for am, den e tell am, “E get one tin wey yu neva do. Go sell all wetin yu get, give poor pipol di money and yu go get plenty propaty for heaven. Den make yu kom follow mi.”
Wen Jesus hear wetin di man tok, e kon tell am, “E still get one tin wey yu neva do, make yu sell evritin wey yu get, give di money to poor pipol, den yu go get betta propaty for heaven. Afta dat, make yu kom follow mi.”
wot of Christ blood wey klean us from deat, so dat wi go fit woship God? Dis na di Christ wey offa ensef to God as di rite sakrifice for awa sins and e do am with di Holy Spirit pawa.
Dis show how baptizim go save us, nor bi just to wosh dirty komot for pesin body, but na to show sey wi get good mind for God thru di way wey Jesus Christ take raiz-up
But if wi dey inside di lite as en ensef dey inside lite, all of us go bi en friend and Jesus wey bi en pikin, go use en blood take wosh all awa sins komot.