Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Pita 1:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 Like dis too, wi don get betta promise and bikos of dat, wi go get God karata wey go free us from di bad tins wey dey for dis world.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Pita 1:4
25 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

wey bi Israel pipol, go fit asept Christ. Na dem God choose as en own shidren, E make agriment with dem kon give dem en law. Na dem get di temple and wetin God promise.


And evritin wey God promise us, na “Yes” thru Jesus Christ. Dat na why awa “Amen” thru Jesus Christ dey give God glory.


All of us wey don bilive Christ, God glory dey show for awa face. So di Spirit dey help us shange, so dat wi go bi like Christ.


Christ still sey, “Make una kom out and separate unasef from dem,” and “Make una nor tosh anytin wey nor dey klean, den I go welkom una


Wi know sey God make dis promise with Abraham and en pikin. God word nor sey, “to di shidren”, but e sey, “and to yor pikin,” and e mean only one and dat one, na Christ.


bikos di pesin wey dey live akordin to en flesh, go reap bad tins, but di pesin wey dey live akordin to God Spirit, go reap life wey nor dey end.


so dat wi go bi one for di tins wey wi bilive and wey go make us really know God Pikin. Den, wi go dey tink like Christ.


Make una wear di new pesin, so dat una go dey new as una dey learn to know and bi like di Pesin wey kreate una.


Awa papa dey ponish us for dis world as e good for dia eye, but God dey ponish us for awa own good, so dat wi go follow am share en holiness.


Na dis make am bi middo-man for di new kovenant, so dat pipol wey e koll go fit receive di propaty wey go dey forever. E promise us dis propaty, wen e die to free us from di bad-bad tins wey wi don do wen di first kovenant still dey.


But betta relijon wey nor get stain for God eye, naim bi dis: to kare for shidren wey nor get papa and mama and wimen wey dey sofa bikos dia husband don die. So, make una keep unasef, so dat dis world nor go stain una.


Na mi Pita wey bi Jesus Christ savant and apostle, rite dis leta to di pipol wey get di same faith wey wi get. God give una dis faith, bikos of en raitiousness wey kom thru awa Oga God and Savior, Jesus Christ.


But as God promise, wi dey wait for di new heaven and eart, di place where raitiousness dey.


Nor bi sey God nor fit do wetin E promise as some pipol dey tink, but E dey patient dey wait for una, bikos E nor wont make anybody die trowey, but E wont make evribody turn from sin kom meet am.


Dis na di promise wey Christ ensef promise us sey, di life wey e go give, nor go ever end.


My friends, wi bi God shidren naw and wi neva know as wi go bi wen Christ go kom back. But wi know sey wi go bi like am, bikos wi go si am just as E bi.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ