One day wen Moses dey kare for di sheep and goat wey bi en wife papa, Jetro wey bi priest for Midian own, e kon karry di animals go far for anoda side for di wildaness till e rish di holy mountin for Horeb.
So, great Zion, God hill wey dey holy, no evil or wahala go dey der again. Just as wota dey full sea, na so too God word go full pipol heart for di land.
“I go bring una kom Zion wey bi my holy hill kon give una joy wen una enter my prayer house, den I go asept di sakrifice wey una go offa for my altar. Dem go koll my temple, ‘Prayer house’, for all di nashons.”
And naw, Oga God sey, “I dey go back to Jerusalem kon stay for Zion wey bi my holy town. Den pipol go koll Jerusalem ‘Di town wey dey faithful’ and dem go koll Oga God mountin, ‘Di holy mountin.’ ”
Di oga among God sojas for heaven kon tell Joshua, “Make yu pul yor sandals, bikos di place wey yu stand put so, dey holy.” So Joshua do as di man kommand am.