But who go fit bear di day wen E go kom? Who go fit survive wen E go appear? Bikos E go bi like strong soap wey dey spoil klot and like fire wey dey melt iron.
As Jesus sidan for Mount Olives, en disciples kom meet am for korna ask am, “Make yu tell us wen dis tins go happen? How wi go take know sey di time wen yu go kom, don rish?”
Den di Word kon shange to pesin and e stay with us for dis world. Wi si en glory wey show sey, naim bi di only pikin wey get korrect favor and trut, wey God send kom meet us.
but di true message about Jesus wey dem kill for cross, naim wi dey prish and di message bi like stone wey Jew pipol kick by mistake kon fall, but to Gentile pipol, na yeye tin e bi.
Wi nor bi like odas wey dey do God word like sey na sometin wey dem fit sell; but bikos na God send us kom, wi dey tok di trut for en present, as Christ savant.
But wi don stop to dey do wiked tins wey pipol dey hide dey do; wi nor dey do wayo or lie join God word, but with trut wey evribody fit si, wi dey make evribody know for dia mind sey, wetin wi dey do, dey good for God eye.
So make wi nor bi like shidren wey breeze dey karry up-and-down; shidren wey dey follow yeye tins wey human being dey tish and na dis tins dem dey take deceive pipol.
but dey waste oda pipol time with di words wey dem dey tok. Dis kind tin dey make pipol live yeye life, instead of to dey hear God word wey dey make pesin faith strong.
(Make una look! E dey kom back inside di kloud and evry eye go si am. Even doz wey shuk am and all di tribes wey dey dis eart, go kry bikos of am. Dis tins go really happen! Amen.)