Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Pita 1:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 As long as I dey, I look am sey e good make I dey remind una,

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Pita 1:13
11 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Dem skata where I dey stay won kon take my life like tent wey dem pul from groun; like klot wey dem kut komot from machine. Yes! I bin tink sey God won end my life.


So Oga God kon help Zerubabel wey bi govnor for Judah; Joshua wey bi di High Priest and all di pipol wey kom back from Babilon, so dat dem go fit do di work. All of dem kon start to build Oga God temple. Dem start di work


So wi dey always get di mind sey wi go die komot from dis world, so dat wi go-go stay with Jesus Christ for where e dey.


So e dey good for mi to dey tink about una like dis, bikos una dey my heart. Una don follow mi share from God favor, even wen I dey prison and wen I dey prish di trut about di gospel.


Wetin I wont na to know am and di pawa wey wake Christ from deat; to sofa wetin e sofa; to bi as e bi wen e die,


Na dis make mi dey remind yu sey, make yu dey use God gift wey yu get well and yu receive dis gift afta I lay hand for yor head.


Make una remember doz wey dey prison, like sey unasef dey der with dem and make una remember doz wey dey sofa, like sey una dey sofa like dem.


I go dey remind una dis tins evritime, even doh I know sey una know dem and naw, una leg don strong for di trut wey una bilive.


as I know sey di time wey I go die don near, bikos awa Oga God Jesus Christ don show mi.


My friends, dis na di sekond leta wey I dey rite to una, so dat una go dey tink about di tins wey I tell una.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ