Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kronikles 9:24 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

24 Evribody wey dey kom visit Solomon, dey bring gift wey bi gold, silva, klot, war tins, spices, horse and melu kom meet am.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kronikles 9:24
11 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Sheba kween give Solomon all di gifts wey e bring and dem heavy rish 120 pounds for gold, with plenty spices and jewels. Di spices wey e give Solomon, plenty pass di ones anybody don ever gi-am before.


Evribody wey dey kom, dey bring gold, silva, robes, weapons, spices, horse and mule. And dem dey bring dem kom evry year.


Before dis time, Hiram don give Solomon gold wey heavy rish 120 pounds.


Some Filistia pipol bring many silva and gold as gifts kon give Jehoshafat. Arab pipol bring 7,700 rams and 7,700 goats from dia animals kon gi-am.


Kings from evriwhere dey kom meet am make dem for hear from di wisdom wey God gi-am.


Den di kween give di king gift wey bi 9,000 pound of gold, many spices and precious jewels. E nor get any spices wey fine rish di ones wey Sheba kween give King Solomon.


Job brodas and sistas plus en friends wey run leave am before kon visit am and dem do party for en house. Dem kom tell am sey, “Wi dey sorry for all di trobol wey God kause for yu.” So all of dem kom give Job money and gold rings.


Make Yu ponish dat wiked animal wey dey wota and di nashons wey dey follow am, until dem go honbol demsef kon offa gold and silva give Yu. Make Yu skata doz pipol wey like war.


Tarshish kings for west and di oda kings go kon pay respet to am. Sheba kings for east and Seba go kon gi-am gifts.


But wen Israel pipol kry give God for help, God kon still send one man go save dem. En name na Ehud, Gera pikin. Na left hand e dey use pass and e kom from Benjamin tribe. Israel pipol send Ehud go meet King Eglon for Moab with many gift.


But some wiked pipol sey, “How dis man go fit take save us?” Dem curse am and dem nor gri kom gi-am gift. But Saul nor tok anytin.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ