2 Kronikles 9:21 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
21 Di king get many ship wey go Tarshish with Hiram savants. Wons evry three years, di ship dey kom back with plenty gold, silva, ivory, apes and peacocks.
Solomon get plenty ship wey dey move with Hiram ship. Wen Solomon ship dem kom back evry three years, dem dey bring gold, silva, ivory, apes and fawol kom.
Hiram send sheep and some pipol wey sabi kontrol sheep go meet am. Men wey know how to drive for sea. Dem drive with Solomon men go rish Ofir kon take 450 gold from der, den dem bring am kon give King Solomon.
All di cup wey king Solomon dey take drink wota or wine, na betta gold dem take make dem, just like all di tins wey dey di palis for Lebanon Forest. Dem nor make dem with silva, bikos wen Solomon dey rule, e nor si silva as anytin!
Na silva and gold from Spain and Ufaz dem take kover di juju. Na doz wey sabi karve make am with dia hand kon dress am with violet and purpol klot wey dem weave.
Rhodes pipol dey buy and sell with una; many pipol wey dey stay near sea dey give una ivory and eboni wood, so dat una go give dem some of wetin una get.
But Jonah kon plan to run go anoda place, bikos e nor won do wetin God tell am. E travel go Joppa where e for si one ship wey karry load dey go Tarshish. So e buy tiket kon enter di ship, so dat e go fit hide from God.