Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kronikles 9:20 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

20 All di cup wey king Solomon dey take drink wota or wine, na betta gold dem take make dem, just like all di tins wey dey di palis for Lebanon Forest. Dem nor make dem with silva, bikos wen Solomon dey rule, e nor si silva as anytin!

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kronikles 9:20
9 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Na gold dem take make di cup wey Solomon take dey drink wota and all di spoons and plates wey dey di hall for Lebanon forest. Dem nor use silva, bikos silva nor get value for Solomon time.


E still get twelf oda image like lion for di six step; one lion for each end for di six step. E nor get any oda throne for di world wey dem fit use take kompare dis one!


Di king get many ship wey go Tarshish with Hiram savants. Wons evry three years, di ship dey kom back with plenty gold, silva, ivory, apes and peacocks.


Di king make silva plenty for Jerusalem like san-san. Cedar wood plenty, just as sikamore fig tree plenty for di low lands.


Na gold cup dem take serve drinks and all di cup get difren design. Di king give dem enough royal wine.


So make una stop to trust human being, bikos dem just dey breath thru dia nose. Wetin dis pipol bi sef? So make una stop to trust human being pawa. All of dem go die one day, so how dem won take help una?


Una go plant vineyard on-top Samaria hill again and di pipol wey plant dem, go chop from dem.


I tell una true word, even Solomon, upon all di money wey e get, e nor wear klot wey fine rish di ones wey dis flower dem dey wear!


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ