17 Di king make one big throne wey dem design with ivory kon dekorate am with gold.
E still make 300 small shield with gold; na 300 gold wey dem melt for fire, dem take make each one. Di king put dem for di palis for Lebanon Forest.
Di throne get six steps and di place where dem go put leg on-top, na gold dem take do am. Di throne get where dem go rest hand put for di two side and one image like lion dey for di two side for di throne.
Na myrrh, aloe and kassia dem spray as perfume for yor klot. Dem dekorate yor palis with ivory and na harp dem take dey entertain yu for der.
Den I si one big white throne and di Pesin wey sidan put. Eart and heaven run komot from en present and dem nor si where to hide put.