Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kronikles 7:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 God appear to am for nite kon sey: “I don ansa yor prayers kon choose dis place as my temple where dem go for dey make sakrifice.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kronikles 7:12
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wen Abram na ninty-nine years, God appear to am kon sey, “Na mi bi di Oga God wey get pawa. Follow mi waka and nor-tin go do yu.


God appear to am again, just as E do for Gibeon.


Elijah kon tell Elisha, “Make yu stay here wait mi, bikos God send mi go Jordan River.” But Elisha ansa, “As long as God and yu dey alive, I nor go leave yu.” So dem kon go togeda.


“Make yu go back go meet Hezekaya, wey dey rule my pipol kon tell am sey, ‘Mi God wey bi yor grand-grand papa David God don hear yor prayer and si as yu dey kry. I go heal yu and afta three days yu go-go back to di temple.


E put Asherah juju wey e make for di temple, di place where God don tell David and en pikin, Solomon sey, “Dis temple for Jerusalem wey I don choose from all di tribes for Israel, go bi where I go stay forever.


Dat nite, God appear to Solomon kon tell am, “Make yu tell mi wetin yu wont make I do for yu.”


I don choose and santify dis temple, so dat e go bi my permanent house; I go always dey here.


Oga God, na Yu bi di hope wey poor pipol get. True-true, Yu go hear dia kry kon konfort dem.


But God dey hear and listin to my prayers.


Den God go happy with di kind sakrifice wey Judah and Jerusalem pipol go bring kom gi-am, just as E dey happy with dem before.”


But di angel tell am, “Make yu nor fear Zekaraya, bikos God don hear yor prayer. Yor wife Elizabet go born boy pikin for yu and yu go koll am, ‘John.’


E kon sey, ‘Kornelius, God don hear yor prayer and E don remember all di good tins wey yu dey do.


una must bring evritin wey I kommand una: una burnt ofrin; sakrifice ofrin; tithe and vow ofrin kom di place wey God choose as where dem go for woship and honor en name.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ