Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kronikles 7:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 For di twenty-third day for di sevent mont, Solomon kon tell all di pipol make dem dey go dia house. Dem happy well-well as dem dey go, bikos of di good tins wey God don do for David, Solomon and Israel pipol.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kronikles 7:10
22 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

For di Fifteent day, Solomon kon sey make all di pipol go dia house. All of dem praiz God kon happy go dia house, bikos of all di blessings wey E don give David, en savant and all Israel pipol.


King Hezekaya and all di pipol happy well-well for wetin God do for dem, bikos E kwik-kwik do am.


Di party for Jerusalem big pass anytin wey don happen for Jerusalem, since wen Solomon wey bi David pikin, bi king.


My Oga God, make Yu and di box wey dey show as yor pawa bi, enter and stay dis temple forever! Make yor priests si as Yu dey diliver pipol! Make doz wey dey obey Yu happy for di blessings and propaty wey Yu dey give!


Afta Solomon don build God Temple, di royal palis and evritin wey e plan for God Temple and en royal palis finish,


For di eight day, dem gada evribody togeda, bikos dem don dedikate di altar for seven days kon celebrate for anoda seven days.


“Naw, make una go house go celebrate. Share food and wine with pipol wey nor get. Today na holy day for awa Oga God, so make una nor kry, bikos na God happiness dey make una strong.”


Make una happy as una dey woship God. Make una sing with joy as una dey kom meet am.


Make wi praiz en holy name and wi wey dey woship God, make wi happy.


Make I share for di joy wey Yu dey give to di pipol wey Yu choose. Make I happy, bikos yor pipol dey happy; make I praiz Yu with doz wey bi yor own.


So, doz of una wey get pure heart and dey raitious, make una happy well-well!


My God, Yu dey make mi happy bikos of evritin wey Yu do and I go sing praiz Yu, bikos Yu dey good to mi.


Jetro, Moses wife papa, wey bi priest for Midian kon hear all di tins wey God don do for Moses and Israel pipol. How God take free dem from Egypt.


For di Festival wey go start for di Fifteent day for di seven mont, di prince go offa di same sakrifice for sin for dat seven days. E go burn di same ofrin kon give di same korn and olive oil.”


Di warda bring dem enter en house kon put food for tabol make dem chop. E happy well-well sey en and en family don bilive God.


Dem dey stay togeda evriday like one big family. Dem dey gada go di temple togeda and dem dey go from house to house, dey chop togeda with happiness.


For der, una must celebrate for di Oga una God present, with all una shidren, savants and Levi shidren wey dey stay una town, (bikos dem nor get land or propaty among una).


Una must chop dis tins for di Oga una God present and e go bi for di place wey E choose. Make una chop for der with una shidren and Levi wey dey stay with una and for evritin wey una dey do, make una dey celebrate for di Oga una God present.


For der, una with una family go chop for di Oga una God present and una go happy for evritin wey una get, bikos di Oga una God don bless una.


Dis na time to celebrate before di Oga una God for di place wey dem for dey woship am; di place wey E choose sey make dem honor en name. Make una celebrate with una shidren, all una savants, Levi pipol for una town, strenjas, shidren wey nor get papa and mama again and wimen wey dia husband don die wey dey stay with una.


Wen una dey celebrate dis feast, make una happy with una shidren, all una savants, Levi pipol for una town, strenjas, shidren wey nor get papa and mama again and wimen wey dia husband don die, wey dey stay with una.


Make una always dey happy inside Christ. I dey tok again sey, make una dey happy!


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ