Only one day for yor house betta pass one tazon years for anoda place! E betta make I bi gateman for God house dan to dey enjoy life for wiked pipol house.
My pipol, make una open una ear as una dey kom meet mi; make una kom meet mi and una go get life! I go give una kovenant wey go last forever kon give una di blessings wey I promise David.
God wey dey mighty, en Spirit dey on mi, bikos E don anoint mi to prish good news give poor pipol; heal doz wey dia heart break; announce make dem release doz wey bi slave and free doz wey dey for prison.