Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kronikles 6:41 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

41 My Oga God, make Yu and di box wey dey show as yor pawa bi, enter and stay dis temple forever! Make yor priests si as Yu dey diliver pipol! Make doz wey dey obey Yu happy for di blessings and propaty wey Yu dey give!

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kronikles 6:41
24 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

David stand for dia front kon sey, “My kountry pipol, make una listin to mi. I bin won build betta house for God Kovenant Box, where God go stay. I don prepare tins to take build betta temple for God.


Yor pipol seize strong-strong towns; betta-betta land; house wey propaty full; well wey dem don dig; olive trees; fruit trees and vineyards. Dem chop anytin wey dem wont kon fat and dem enjoy all di good tins wey Yu give dem.


God go make yor kingdom big and strong for Jerusalem and yu go rule ova yor enemies.


I go protet en priests and joy go full di heart of doz wey dey fear God.


Yu crown di year with yor good blessing and even where hard pass, still dey produce plenty food.


But blessing go follow di pesin wey Yu choose to stay yor palis. Make di good tins wey dey yor house, yor holy place, beleful us.


Jerusalem pipol dey happy, bikos of wetin God don do. E bi like yong woman wey dem dress ready for marriage. God don wear salvashon and viktory klot for en body.


E sey, instead of sadnes, E go give joy and happiness to doz wey dey mourn for Zion. Instead of sorrow, E go put praiz song for dia mout. Dem go bi like tree wey God plant by ensef. All of dem go do wetin dey rite and dem go praiz God for wetin E don do.


Dem go know una as God priests wey bi en savant. Una go enjoy di nashon propaty. Den una go dey proud sey na una own.


God sey, “Heaven na my throne and na di eart I dey put my leg. Wish kind house una go fit build for mi? Wish kind place I go stay?


Dem go dey good and fine well-well! Di korn and wine wey di yong pipol go dey chop and drink, go make dem grow and dey strong.


I nor dey shame to prish God word, bikos na-im bi di pawa wey God take dey save doz wey bilive am, weda dem bi Jew or Gentile pipol.


Instead, make una wear Jesus Christ like klot for body. Den wi nor go do di tins wey awa body wont.


Una wey dem don baptize inside Christ, don wear Christ for body like klot.


Na wi bi di really sekonsishon; di pipol wey dey woship God thru en Spirit; pipol wey dey happy inside Christ and wi nor dey put awa hope for wetin pipol dey do.


Make una always dey happy inside Christ. I dey tok again sey, make una dey happy!


Di priests wey karry God wey dey rule di whole world Kovenant Box, as dia leg tosh di wota for Jordan River, dat place go divide for una.”


Di sojas wey dey heaven, wear white linen kon enter white horse dey follow am.


Dem allow am wear klean linen wey dey shine, (Dis linen mean di good tins wey God pipol do).


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ