God tell am, “I don hear yor prayers. Dis temple wey yu build for mi, I don make am holy for mysef and na der dem go for woship mi forever. I go wosh and kare for am always.
My God, make Yu listin well-well! Make Yu open yor eye si tins for yorsef! Listin to di message wey Sennakerib send kom and as e curse Yu wey dey alive!
E klear sey na God dey wosh di whole world and E dey ready to give pawa to doz wey trust am. Yu nor use sense for dis matter, so from naw go, na so-so war yu go dey fight.”
den make Yu listin to dia prayer for help from where Yu dey stay for heaven. Make Yu sorry for dem; help and forgive yor pipol for all di sins wey dem kommit.
Make Yu listin to di prayers wey mi and yor savants wey dey honor Yu, dey pray. Make Yu help mi today, so dat di king go sorry for mi.” For dat time, na mi dey serve di king wine.
My Oga God, make Yu look mi kon hear my prayers for yor savants, Israel pipol, both for day and nite. I konfess sey wi, Israel pipol don sin. Wi and awa grand-grand papa dem don sin.