Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kronikles 6:38 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

38 Wen dem turn kom meet Yu with all dia heart and mind for di land where dem for dey sofa kon dey pray as dem face dis land wey Yu give dia grand-grand papa and di town wey Yu choose with di temple wey I build to honor Yu,

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kronikles 6:38
11 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wen ever Yu sey make yor pipol go fight dia enemies and dem direct dia prayers to Yu kon face dis town wey Yu choose and dis temple wey I build to honor Yu,


Wen yor pipol don know wetin dem do for dat land where dem for bi prisonas, den, dem turn kom meet and dey beg make Yu forgive and remove dem from di land where dem for bi prisonas, den dem go sey, ‘Wi don sin and do anyhow! Wi don do wiked tin!’


den make Yu listin to dia prayer for help from where Yu dey stay for heaven. Make Yu sorry for dem; help and forgive yor pipol for all di sins wey dem kommit.


Wen Daniel hear wetin happen, e kon go en house. E klimb go one room for up wey en window face Jerusalem. Just as e dey do before, e knee down for di window wey open kom pray give God and e dey do am three times evriday.


Den I sey, ‘Oga God, Yu don drive mi komot from yor present kpata-kpata and I nor go ever si yor holy temple again!’


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ