Wen ever Yu sey make yor pipol go fight dia enemies and dem direct dia prayers to Yu kon face dis town wey Yu choose and dis temple wey I build to honor Yu,
Di time dey kom wen yor pipol go sin against Yu (bikos e nor get who nor dey sin!) and Yu go dey vex for dem kon give dem to dia enemies wey go take dem go as prisonas for anoda land, weda e far or near.
Dem don fat and dey chop betta food. Dem nor know wen to stop all di bad tins wey dem dey do. Dem nor dey give doz wey nor get papa dia rite or give betta judgement to doz wey dem dey opress.