make Yu listin to dem from heaven; forgive dia sin kon ansa each pesin akordin to wetin Yu tink sey dey en mind. (True-true, na only Yu fit really know wetin pesin dey tink.)
Strenjas wey nor join yor pipol Israel, go kom from far place, bikos of di respet wey pipol dey give Yu and bikos Yu get pawa to do evritin wey Yu tok; dem go kom dis temple kon pray.
Dat time, di church wey dey Judea, Galilee and Samaria get rest and dis kon make dem strong as dem dey stay togeda, dey woship God with all dia heart and as di Holy Spirit dey tok to dem. So pipol wey dey di church kon dey plenty more-more.