25 make Yu listin to dem from heaven kon forgive yor pipol, den bring dem kom back to di land wey Yu give dem and dia grand-grand papa.
All di land wey yu dey si so, I go gi-am to yu and yor shidren-shidren forever.
If Yu let enemies win yor pipol Israel, bikos of dia sin, den dem kon turn kom meet Yu for dis temple sey make Yu forgive and help dem,
Time dey kom wen di sky go klose and rain nor go fall, bikos yor pipol don sin against Yu. Wen ever dem face dis temple kon pray to Yu, make Yu forgive dem as dem turn from dia sins kom meet Yu, bikos Yu don ponish dem before.
I go take and give una di land wey I promise sey I go give Abraham, Isaak and Jakob. Na mi bi Oga God!’ ”
So God give Israel pipol all di land wey E promise dia grand-grand papa and dem win am kon dey stay der.