kon pray: “Awa Oga wey bi Israel God, e nor get any god wey bi like Yu for heaven or for dis eart! Yu dey show yor goodness to yor savant wey dey obey and respet Yu.
My Oga wey bi Israel God, make Yu do wetin Yu promise yor savant, my papa David, wen Yu sey, ‘Na yor shidren and shidren-shidren go dey rule for Israel, so-far dem do wetin I tok kon obey my laws, just as Yu obey mi.’
God nor dey really stay with human being for dis eart! Si, if di sky and di heavens wey high pass nor rish Yu stay, den how dis temple go take kontain Yu?
Wen poor pipol and doz wey dem dey opress dey look for wota bikos dia trot don dry, den mi, wey bi God go ansa dem. Israel God nor go ever abandon dem.
Den I go keep di promise wey I make with dia grand-grand papa kon give dem betta land. And na di land una dey today so.’ ” Den I sey, “Amen! My Oga God, make e bi as Yu tok!”