Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kronikles 6:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 kon build place for di Kovenant Box and na God make dis kovenant with Israel pipol.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kronikles 6:11
9 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

I don still make place for di temple, where dem go keep di Kovenant Box and di stone wey dem rite di kovenant put, wey God make with awa grand-grand papa wen E bring dem kom out from Egypt, dey inside.”


Na only di stone tablets wey God take make Kovenant with Israel pipol as dem dey kom from Egypt, dey inside di Kovenant Box and na Moses put am wen dem dey Mount Sinai.


Nor-tin dey inside di box escept di two stones wey Moses put inside for Mount Sinai where God for make kovenant with en pipol Israel, afta dem kom out from Egypt.


Di priest karry di Kovenant Box go where dem sey make dem put am for inside di temple, for di Most Holy Place wey dey under di angels image feada.


God don do wetin E promise. I don take-ova from my papa David kon sidan for Israel throne, just as E promise. I don build dis temple to honor di Oga wey bi Israel God


Solomon stand for God altar for Israel pipol present kon spread en hand.


E sey, “Make una bring my pipol wey dey obey mi kom, doz wey make kovenant with mi with dia sakrifice.


E take di testimony stones kon put am inside di box, tie di poles for di box, den put di kover on-top.


Di gold altar where dem dey burn incense and di Kovenant Box wey dem kover with gold, dey der too. Di gold jug wey dem put manna, Aaron rod wey grow leaf and di flat stone wey dem rite di law put, dey inside dis box.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ