“Make yu tell yor broda Aaron sey, na di rite time e go-go di place wey holy well-well for di curtain back, bikos na for der I appear for kloud on-top di Kovenant Box. If e nor do am, e go die.
Oga God nor dey kwik vex, but en pawa dey great. E go must ponish wiked pipol. E dey show en great pawa thru strong breeze and heavy rain. Na di kloud bi di dust wey dey under en leg.