Wen Aaron and en sons don kover di Holy Place and en tools finish; wen time don rish for di pipol to travel, Kohat pipol go karry doz tins; but dem nor go tosh anytin wey dey holy, bikos if dem tosh am, dem go die. Dis na Kohat pipol work for di tent.
So Joshua wey bi Nun pikin kon koll and tell di priests, “Make una karry di Kovenant Box and seven priests must karry seven ram horn for di Kovenant Box front.”