2 Kronikles 5:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
1 Wen Solomon don build God Temple finish, di holy tins wey bi en papa David own (tins like: silva, gold and all di oda tins) e pak dem put inside di store room for di temple.
Wen King Solomon don finish di temple work, e kon put all di tins wey David en papa dedikate give God, inside di temple store room: di silva, gold and all di oda tins.
“But for di temple, I don use my pawa gada almost 4,000 tons for gold and 40,000 tons for silva wey dem go take build am. Dem still dey bring many bronze and iron kom. I don still keep wood and stone wey yu go use, but yu go still nid more.
Na pure gold dem take make di wick iron, di bowl, spoon and di censer. Na gold dem still take make di door-mot, di house front, inside di door and di temple door.