All di good and betta tins wey dey di royal palis and di temple, King Nebukadnezzar pak all of dem. All di gold tins wey King Solomon for Israel make put for God Temple, King Nebukadnezzar remove all of dem, just as God tok.
Di king karry all di tins wey dey God Temple go Babilon; weda di tins big or small, plus all di tins wey dem keep for God Temple, Israel kings and en ofisas store room.
God allow King Nebukadnezzar katch King Jehoiakim and e karry some of di tins wey dey God temple too. E karry Judah pipol as prisonas go Babilon and di tins wey e karry from Jerusalem, e put dem for en own juju temple.