3 King Neko for Egypt take am go prison kon sey make Judah pipol pay 7,500 pounds for silva and 75 pound for gold as tax to am.
Fero Neko katch am put for prison for Riblah wey dey Hamat land, so dat e nor go fit rule Jerusalem pipol. Neko sey make di pipol for di land pay am 7,500 pound for silva and 75 pound for gold.
Jehoahaz na twenty-three years wen e start to rule and e rule three monts from Jerusalem.
Egypt king kon make Eliakim wey bi Jehoahaz broda king for Judah and Jerusalem and dem shange en name to Jehoiakim. King Neko karry Jehoahaz go Egypt.