2 Kronikles 36:23 - Holy Bible Nigerian Pidgin English23 Wetin dem rite na: “King Cyrus for Persia sey: ‘Di Oga God wey dey heaven don give mi all di kingdoms for di world. E don choose mi to build temple for am for Jerusalem wey dey Judah. Naw, make all of una wey bi God pipol go back and di Oga una God go dey with una.’ ” အခန်းကိုကြည့်ပါ။ |
Instead, yu dey against God wey get heaven and eart. Yu bring all di tins from di temple, den yu and yor men, plus yor wife and yor girl-friends kon use dem dey drink wine. Yu dey praiz di gods wey dem make with gold, silva, bronze, iron, wood and stone; gods wey nor even fit si, hear or undastand! But yu neva ever praiz God wey dey kontrol yor life and ways!