2 Kronikles 36:18 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
18 Di king karry all di tins wey dey God Temple go Babilon; weda di tins big or small, plus all di tins wey dem keep for God Temple, Israel kings and en ofisas store room.
Wen di year just start, King Nebukadnezzar kon give orda sey make dem bring am with di betta tins wey dey for God Temple kom Babilon. E make Zedekaya wey bi en family memba, king for en place for Jerusalem.
Dem don tif all wetin e get; all en betta tins don vanish. E dey look as strenjas dey use di holy temple anyhow; di place wey God sey make dem nor enter.
But evritin wey I tok thru my profets, happen to una grand-grand papa dem, just as I tok am. So dem turn from sin kom meet mi kon sey, ‘Oga God wey dey lead heaven sojas, na en really ponish us, just as wi deserve am. E don do wetin E sey E go do.’ ”