Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kronikles 36:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 King Zedekaya attack King Nebukadnezzar wey don make am swear with God name sey e go dey loyal to am. King Zedekaya sturbon well-well and e nor gri turn from sin kom meet di Oga wey bi Israel God.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kronikles 36:13
27 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Gibeon pipol nor dey join Israel pipol; dem bi small tribe for Amor wey Israel pipol promise sey, dem go protet, but Saul don try to distroy dem, bikos of en love for Judah and Israel pipol.


Assyria king find out sey King Hoshea dey plan against am, bikos e don send message go meet King So for Egypt and e nor gri pay tax to Assyria king again. So Assyria king kon arrest and put am for prison.


So bikos God dey vex, di time kon even rish wen God nor won si Jerusalem and Judah pipol for en present again. Leta, King Zedekaya won kon fight against King Nebukadnezzar.


God send profet go meet dem, so dat dem go turn back kom meet am. Dem warn dem well-well, but dem nor gri listin.


Make una nor dey sturbon like una papa, but make una obey God as una dey kom en house wey E don make holy forever. Make una serve am forever, so dat E nor go vex for una.


All di priests and leaders nor kon dey faithful again and dem kon dey kommit bad-bad sins wey all di oda nashon dey kommit. Dem nor kon make God temple for Jerusalem holy again.


Wi wont make di king know sey Jew pipol wey kom from yor oda aria, don dey stay for Jerusalem and dem dey build dat evil and yeye town back. Dem don start to build di wall and go soon finish am.


Yu warn dem sey make dem obey wetin Yu tish, but dem rijet yor law bikos of pride and even doh yor law dey give life, dem nor gri obey am, bikos of dia strong head and sturbones.


Doz wey hate pipol wey dey sin and honor doz wey dey fear and follow God! Pipol wey dey do wetin dem promise even wen e dey pain dem.


With all dis ones, Fero heart still strong well-well and e nor gri listin to dem, just as God tok.


But wen Fero si sey di wahala don end, en heart kon strong more and e nor gri listin to dem, just as Oga God tok.


But Fero heart still dey strong and sturbon as before and e nor gri free di pipol.


Yu still dey karry body up and yu nor gri free my pipol.


Bikos I know how una sturbon rish; una neck strong like iron and una head bi like bronze.


Azaraya wey bi Hoshaaya pikin and Johanan wey Kareah born with di oda sturbon men for Jerusalem kon tell mi, “Na lie yu dey lie! Di Oga awa God nor sey make yu tell us make wi nor go Egypt.


But e kom dey karry body up, dey sturbon and pride kon full en spirit, so God remove am from en throne and e kom lost en respet.


Dia heart strong like rock and dem nor gri obey my profets wey dey among dem. So I vex kon ponish dem well-well.


“ ‘If yong woman wey still dey stay en papa house make vow give God or promise with ensef


“Den di pipol go sey, ‘Na bikos dem nor gri obey di kovenant wey God wey bi dia grand-grand papa God make with dem wen E bring dem kom out from Egypt.


But make una dey enkourage one anoda evriday, so dat non of una go get bad mind, bikos of sin.


Make una nor get strong heart for am, bikos na so Israel pipol do wen God test dem for wildaness.


Joshua promise dem peace kon sey e nor go kill dem. Israel leaders sef agri wetin Joshua tok.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ