Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kronikles 36:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 Zedekaya na twenty-one years wen e start to rule and e rule eleven years from Jerusalem.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kronikles 36:11
9 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

For di tent day for di tent mont for di ninet year wey Zedekaya dey rule, King Nebukadnezzar for Babilon go fight Jerusalem. E build kamp round di town.


God still tok to am, wen Josaya pikin, Jehoiakim dey rule for Judah. Afta dat time, God still tok to am until di fift mont for di elevent year wen Zedekaya wey Josaya born, dey rule for Judah and na dat same year, dem katch and karry Jerusalem pipol go Babilon.


Wen Josaya pikin Zedekaya just bi king for Judah, God tell mi


Dat same year, for di fift mont wey bi di fourt year wey Zedekaya bi king, Hananaya wey bi Azzur pikin, wey bi profet for Gibeon town kon tok to mi for di temple. For di priest and di pipol present, e sey,


But make una listin to wetin God tok about di king wey dey rule David kingdom and di pipol for di town wey bi una relashon, wey dem nor karry as prisonas follow una.


Di Oga wey bi Israel God sey, “Make yu go tell King Zedekaya for Judah sey, ‘Mi, wey bi God, go give dis town to Babilon king and e go burn am rish groun.


But King Zedekaya, en ofisas and di pipol nor gri obey di message wey God send mi.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ