Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kronikles 35:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 En ofisas still use dia mind give di pipol, di priest and Levi pipol some tins too. Priest Hilkaya, Zekaraya and Jehiel wey bi leaders for di temple, give dem 2,600 lamb and yong goats and 300 melu for di Passova.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kronikles 35:8
24 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

I know sey Yu dey test evribody heart and Yu dey like doz wey dey respet diasef. I put my body for groun kon use all my heart take give Yu all dis tins and I don si how all yor pipol dey happy as dem dey give Yu dia gifts.


Finehas wey bi Eleazar pikin, na-im dey lead dem before and God dey with am.


King Hezekaya give di pipol 1,000 bulls and 7,000 sheep. Di ofisas still give dem 1,000 bulls and 10,000 sheep. Many priest santify diasef too.


Jehiel, Azazaya, Nahat, Asahel, Jerimot, Jozabad, Eliel, Ismakaya, Mahat and Benaya dey work under Kenanaya and en broda Shimei wey bi di oga for God Temple, bikos na so King Hezekaya and Zabud wey bi oga for di temple, wont make e bi.


Di money wey Levi pipol wey dey guide don kollect for di temple, dem pak and gi-am to Hilkaya wey bi di High Priest. (Dem kollect am from Manasseh, Efraim and all di pipol wey remain for Israel, Judah, Benjamin and Jerusalem.)


Josaya give di pipol 30,000 lamb and goats with 3,000 melu from en animals for di Passova sakrifice.


All dia neighbours give dem tins like gold, silva pot, food, animals, oda betta tins and ofrin wey dem go use take ribuild God Temple.


Make yu still take all di gold and silva wey yu fit kollect from Babilon and di ofrin wey Israel pipol and dia priests give for dia Oga God Temple for Jerusalem.


Rish pipol from Tyre town go kom give una gifts. Doz wey get money go kom make una help dem.


Den di leaders for Israel, di heads for di tribes kon give one ofrin. Na dis pipol bi leaders for di tribes and na dem dey monitor di kountin.


As Pita and John still dey tok, di priests, di temple guide oga and di Sadusi pipol waka kon meet dem.


So di soja oga wey dey di temple kon escort di savant go bring di apostles, but dem nor use force, bikos dem dey fear sey di pipol wey gada der, fit stone dem.


Bikos if e really dey una mind to do am, anytin wey una give akordin to wetin una get, God go asept am, but nor bi wetin una nor get.


Make each of una give as e plan for en mind; nor bi with regret or like sey dem force am, bikos God love pesin wey dey give with happiness.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ