12 Den dem divide di burnt ofrin among di pipol akordin to dia family, so dat dem go fit offa dem akordin to di kommand wey Moses give dem.
Dem kill di Passova lambs, den di priest sprinkol di blood for evriwhere. Na Levi pipol prepare di animals.
Levi pipol roast di Passova lambs just as dem rite am for di Law Book kon boil di holy ofrin inside pots, kettol and pans, den serve di food give all di pipol.
“ ‘If na burnt ofrin from en animals, e must bring man own wey dey okay kom Tabanako, so dat God go asept am.
kon give all dis parts for di animal to God as food ofrin: all di fat wey dey inside di animal intestine;
Di priest go burn all of dem for di altar with di burnt ofrin. God like dis food ofrin smell well-well.
But una must offa food ofrin to God: two melu, one ram and seven man lamb wey bi one year and dem must dey okay.
Una go offa dem with di wine ofrin plus di normal burnt and korn ofrin and dem must dey okay.