1 Josaya celebrate God Passova for Jerusalem. Dem kill di Passova lamb for di fourteent day for di first mont.
Dem kill di Passova lambs, den di priest sprinkol di blood for evriwhere. Na Levi pipol prepare di animals.
Make una kill di Passova lamb, dedikate and prepare unasef for una pipol kon do wetin God kommand una thru Moses.”
Di pipol wey kom back from Babilon celebrate Passova for di fourteent day for di first mont.
“ ‘Una must kare for am until di fourteent day for dis mont, den for evening, di whole kommunity for Israel go kill all di animals.
“For di fourteent day for di first mont, yu go start to celebrate di Passova Feast. For seven days, evribody go chop bread wey nor get yist.
For di fourteent day for dis mont, wen evening don rish, una go do di Passova; una must keep am akordin to di rule and kommand.”