King Hezekaya send message go Israel and Judah kon rite leta go give Efraim and Manasseh pipol sey make dem kom God Temple for Jerusalem kon celebrate di Passova to take honor di Oga wey bi Israel pipol God.
Afta di feast, Israel pipol for Judah kon go skata di pilas, Asherah juju pole, all di high place and altar where dem for dey serve juju for Judah, Benjamin, Efraim and Manasseh tribes. Den all of dem kon go back to dia house.
Na so too shuku-shuku go kover all di tins wey dem plant for di hill and nobody go fit go der again. E go bi where melu and sheep for dey go chop grass.”