Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kronikles 34:22 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

22 So Priest Hilkaya and di oda pipol wey di king send with dem kon go meet Profetes Hulda wey dey stay di new part for Jerusalem. (En husband na Shallum wey Tokhat born and na Hasrah wey dey kare for di temple robe, bi en grand-papa.) Dem kon tell di woman evritin wey happen,

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kronikles 34:22
9 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So Priest Hilkaya, Ahikam, Akbor, Shafan and Asaya kon go meet Profetes Hulda wey bi Shullam wife. Shullam papa na Tikvah and na Harhas wey dey kare for di wardrobe bi en grand-papa. (Di woman dey stay for Mishneh aria for Jerusalem.) Dem go meet am kon tell am wetin make dem kom,


“Make una go pray give God for mi and di pipol wey remain for Judah and Israel. Den ask am about di words wey dey dis book wey dem si, bikos God dey vex for us, bikos awa grand-grand papa nor obey en word as dem rite am for dis book!”


den di woman sey, “Make una go tell di king,


Den Miriam, Aaron sista wey bi profet kon take en sheke-sheke and all di rest wimen follow am too dey play dia sheke-sheke as dem dey dance.


God sey, “For dat day, pipol go kry dey kom from di Fish Gate and dem go dey shaut from di new house dem wey dey di town. And una go hear strong nois from di hills.


One profetes dey, wey en name bi Anna, Fanuel dota, wey kom from Asher family. E don old well-well and e marry en husband for seven years, before di man die.


(E get for dotas wey neva marry, wey dey profesai.)


Dat time, Deborah wey bi Lappidot wife, na profetes and judge for Israel.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ