Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kronikles 34:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 E do wetin God wont kon follow David wey bi en grand-grand papa footstep, e nor turn go left or rite.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kronikles 34:2
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

I take di kingdom from David shidren-shidren kon give yu. But yu nor bi like David my savant wey always dey obey and do only wetin I like.


God do like dis, bikos David do wetin E like and e nor disobey any of en kommand, apart from Uriaya from Hit wey e kill.


E do wetin God kommand kon dey work like David, en grand-grand papa. E nor do bad tins at-all.


God bin dey with Jehoshafat wen e start to rule, bikos e dey obey God like David en grand-grand papa. E nor gri serve juju,


instead e serve and obey en grand-grand papa God. E nor do like Israel pipol.


E obey God, just like David en grand-grand papa do.


For di eight years wen e dey rule, even doh e still dey yong, e start to serve God wey en grand-grand papa David serve. For di twelft year, e bigin distroy all di place where dem for dey serve juju: Asherah juju and all di oda juju.


Make yu run from bad tins kon waka for strait road, so dat yu nor go turn go left or rite.


Afta dem don read di law kon pass judgement, una must do anytin wey dem tok; make una nor try to shange wetin dem tok at-all.


As e dey read am evriday, e nor go dey proud and e nor go do like sey e important pass evribody. Dis nor go let am turn from dis kommand at-all. And e go make en and en shidren-shidren reign as king for Israel forever.


Make una nor turn from any of dis kommand wey I dey give una today or go follow and woship oda gods.


So make una dey kareful kon do as di Oga una God kommand; make una nor turn go rite or left!


Make sure sey yu dey strong well-well and yu get heart! Make yu dey obey all di law and kommand wey my savant Moses give yu! Nor do dem anyhow, den yu go prosper for evritin wey yu dey do.


“Make una dey strong! Make una dey obey evritin wey dem rite for Moses book with kare, so dat una nor go fall go left or rite,


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ