Dem sey make dem go koll di king kom, so Hilkaya pikin, Eliakim wey dey guide di palis, with Shebna wey dey rite wetin dey happen for di palis and Joah pikin Asaf wey bi di palis seketry kon go meet dem.
Make e always keep dat kopy with am evriday as long as e dey alive. Like dat, e go learn how to fear di Oga en God as e dey obey all di laws and kommand.
Dis law wey God give yu must nor komot from yor mout! Yu must dey read and tink of am evriday and nite, so dat yu go fit obey evritin wey dey inside. Den yor way go dey rite and evritin go betta for yu.