Manasseh still kill many innocent pipol and dia blood don stain Jerusalem from one end go rish di oda end. E even still dey enkourage Judah pipol to sin against God.
I nor go make Israel pipol leave di land wey I give dia grand-grand papa again, as long as dem dey obey di kommand, laws and rules wey I give dem thru Moses, my savant.”
“So Jerusalem pipol make una listin: Na mi bi Oga God! Una nor gri obey my laws or tishings, instead una dey do wetin di oda nashons dey do. Una even sturbon pass di tribes wey dey near una.
Una dey obey only King Omri wiked laws and una wiked like King Ahab! So, I go use una as ezample kon distroy una finish. Dem go ponish una and evribody wey si una, go laf well-well.”
“ ‘Den I kon bring una kom Amor pipol land wey dey east for Jordan River. Dem fight with una, but I make una win dem; una kollect dia land and I distroy dem finish for una front.