Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kronikles 33:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 E sin like di oda kings and nashons wey God porshu komot di land for Israel pipol.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kronikles 33:2
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Just as di kountries wey God porshu dey do, na so too Israel pipol dey burn incense for all dia juju altar. Di bad tins wey dem dey do kon make God vex well-well.


Dem rijet en rules; di kovenant wey E make with dia grand-grand papa and di laws wey E sey make dem obey. Dem dey respet juju wey nor mean anytin and like dis, dem nor mean anytin to God again. Dem dey bihave like di kountries wey dey around kon make God dey shame for dem.


E nor gri obey God and e kon dey sin like di oda kountries wey God drive komot der.


But dem nor gri obey and Manasseh make all of dem bigin sin pass di kountries wey God distroy bikos of Israel pipol.


E use en sons take do sakrifice for Ben-Hinnom Valley and na dis kind sins di nashons wey dey der before, dey do wey make God drive dem komot di land.


E nor obey God just as Manasseh en papa bin do. E do sakrifice for all di juju wey en papa make.


All di priests and leaders nor kon dey faithful again and dem kon dey kommit bad-bad sins wey all di oda nashon dey kommit. Dem nor kon make God temple for Jerusalem holy again.


So, how wi go forget yor kommand again kon go marry doz wiked pipol? If wi do am, Yu go vex kon distroy us finish and nobody go survive.


and I go make all di pipol for di world dey fear, bikos of wetin happen. Dem go fear, bikos of wetin Judah king, Hezekaya wey Manasseh born, do for Jerusalem.” ’ ”


Den una go know sey na mi bi God! Una dey keep oda nashon law, but una dey break my own and nor dey obey my kommand.’ ”


Wen di Oga una God dey go for una front go distroy all di kountries and una drive dem komot kon stay di land,


Una must nor woship di Oga una God, just as di oda kountry dey woship dia own gods, bikos all wetin dem dey do take woship dia gods, na tins wey una Oga God hate well-well. Dem even dey burn dia shidren as sakrifice for dia gods.


Di pipol wey una won porshu dey do dis tins, but di Oga una God dey sey make una nor do dis kind tin.


Wen una enter di land wey di Oga una God dey give una, make una nor learn wetin di oda kountries for der dey do.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ