2 Kronikles 32:30 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
30 King Hezekaya block where wota from dey kom on-top Gihon kon direct am go di west side for David Town. So, God kon bless King Hezekaya for evritin wey e do.
Di remainin tins wey Hezekaya do, plus all wetin e get and how e build pool where wota go from dey kom di town, dem rite am put for Judah kings history book.
Afta dis, Manasseh build di outside wall for David Town for di west side for Gihon Valley go rish di Fish Gate and di oda gates. E make am high well-well kon put sojas for evriwhere for di town wey dem fence for Judah.