Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kronikles 32:29 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

29 E build royal towns and e get many sheep and melu, bikos God gi-am many propaty.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kronikles 32:29
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Na from Yu money and propaty from dey kom. Na yor strent and pawa Yu take dey rule evritin and Yu fit make anybody big and strong.


E die wen e don old well-well. E get many propaty and evribody dey respet am. Solomon en pikin kon take-ova from am as king.


Bikos God guide en kingdom, Israel pipol kon take gift go give Jehoshafat, so e get enough money and pipol kon dey respet am.


Den King Amazaya kon ask di profet, “Wetin yu wont make I do about di money wey I don pay take hire dem?” Di profet ansa, “God go give yu pass dat one.”


E still build towas wey e fence; dig many well for di desert, bikos e get many animals for di hills and plain land. E get pipol wey dey work for am for en farm, vineyard, di hills and for Mount Karmel, bikos e like farm work well-well.


E still build store for en rice wey dem harvest, en wine, olive oil and for en plenty animals.


E till get 7,000 sheep, 3,000 kamel, 500 oxen, 500 donkey wey bi woman, plenty savant and na-im get money pass for di east side for di kountry.


Satan ansa, “Job go gri woship Yu, if e nor get anytin wey e go gain? Yes, Job get good rizin to fear God.


God bless di remainin days wey Job stay for dis eart pass wen dem born am. Job kom get 14,000 sheep, 6,000 kamel, 2,000 kattle and 1,000 donkey.


Wen God bless pesin, e dey get enough and nor-tin go make am regret.


Una must remember di Oga una God, bikos na en dey give pipol di pawa to make money. If una obey am, di kovenant wey E make with una grand-grand papa, E go make am happen for una life.


E dey make some poor kon make odas rish. E dey honbol some kon make odas great.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ