King Asa pray to di Oga wey bi en God sey, “My Oga God! Na Yu dey make weak pipol strong. Wi dey go fight dis many sojas, bikos wi bilive sey Yu go help us.”
God kon send angel go kill all di soja, prince and offisa for Assyria. So, King Sennakerib kon shame go back to en town. Den wen e go en god temple, en sons kon kill-am with swod.