Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kronikles 32:17 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

17 E rite leta kon curse di Oga wey bi Israel pipol God sey: “Di gods for all di nashons nor fit save dia pipol from my pawa. Even King Hezekaya God nor go fit save en pipol from my pawa.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kronikles 32:17
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

True-true yu don hear wetin Assyria king do to di oda lands. Yu tink sey God go save yu?


Where di kountries wey my grand-grand papa dem distroy. Where Gozan, Haran, Rezef and di pipol for Eden for Telassar? Dia gods save dem?


Hezekaya take di leta from di messenja kon read am, den e go God Temple kon spread am on-top di altar.


Na who yu dey trobol and curse like dis? Na who yu dey shaut for and look with bad eye? Na di Holy One for Israel?


I don hear evritin about yor plan for mi and yor pride. From naw go, I go put hook for yor nose kon klose yor mout, den take yu go back thru di same road wey yu take kom.” ’ ”


Di king hear sey, King Tirhakah for Ethiopia dey mash kon fight am. E kon still send message go meet Hezekaya sey:


Any of doz kountry gods don fit save dem from my pawa?


King Sennakerib savants still insult di Oga God and Hezekaya wey bi God savant.


For di fift time, Sanballat send one savant with leta kon give mi.


But God sey, “Axe go fit sey e big pass di man wey dey use am? Abi cutlass dey important pass pesin wey dey use am kut sometin? Nor bi gun dey karry pesin wey hold am, but na di pesin dey karry am.”


Den, King Hezekaya kollect di leta from di messenja, read am kon take am go put for God altar for di temple,


So di beast open en mout dey curse God, en name, where E dey stay and doz wey dey heaven.


David ask di men wey stand near am, “Na wetin dem go do for di man wey go kill dis Filistia man kon free Israel from shame? Bikos who bi dis Filistia man wey nor sekonsaiz, wey dey shalenge God wey dey alive, sojas?”


Yor savant don kill both lion and bear. Dis Filistia man wey dem nor sekonsaiz go bi like one of dem. Bikos e don shalenge God wey dey alive sojas!”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ