Make una nor let King Hezekaya deceive una like dis. Make una nor bilive am, bikos no god for any kingdom don fit save en pipol from my hand or my grand-grand papa dem pawa. So, how una God go take save una from my hand?”
E rite leta kon curse di Oga wey bi Israel pipol God sey: “Di gods for all di nashons nor fit save dia pipol from my pawa. Even King Hezekaya God nor go fit save en pipol from my pawa.”