Wen Pekah dey rule Israel, King Tiglat-Pileser for Assyria kon attack and katch Ijon, Abel-Bet Maaka, Janoah, Kedesh, Hazor, Gilead and Galilee, plus all di aria for Naftali, den e karry di pipol go Assyria.
All di nashons bi like bird house for my hand and I gada dia propaty just as dem dey gada egg. Yes! No feada fit make mi fear and no bird fit open en mout sey e won bite mi!”
Naw, mi Nebukadnezzar praiz, woship and hail di King wey dey heaven. Evritin wey E dey do dey rite and en ways dey pure. Pipol wey dey karry body up, E dey bring dem down.
Yor papa great well-well, sotey all di pipol, nashon and language dey shake and fear am. E dey kill who e won kill kon honor who e like honor or disgrace who e won disgrace.
And una don si and hear sey dis Paul don take many pipol komot from awa hand. Nor bi only for dis Efesus, but for di whole Asia, bikos e dey tell dem sey di gods wey dem mold, nor bi god at-all.