Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kronikles 32:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 King Hezekaya tell una sey, ‘Di Oga wey bi awa God go save us from Assyria king pawa.’ But e dey deceive una and honga for food and wota go kill una.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kronikles 32:11
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

But di shief adviser ansa, “My masta nor send mi sey make I kon tok dis message to only una and una oga. Dis message na for di pipol too wey sidan for di wall, bikos dem go chop dia own shit kon drink dia piss.”


Make una nor let Hezekaya tell una sey, ‘Make una trust God, bikos E go save us; so Assyria king nor go fit do us anytin.’


“Make una tell King Hezekaya for Judah sey: ‘Make yu nor let di God wey yu trust fail yu wen E sey, “Assyria king nor go fit seize Jerusalem.”


Dis na wetin King Sennakerib for Assyria tok, “Why una get heart kon still dey Jerusalem wen sojas surround evriwhere?


Na King Hezekaya skata all God place and altars kon tell Judah and Jerusalem pipol make dem burn incense and woship God for only one altar.


Make una nor let King Hezekaya deceive una like dis. Make una nor bilive am, bikos no god for any kingdom don fit save en pipol from my hand or my grand-grand papa dem pawa. So, how una God go take save una from my hand?”


“Nor bi dis man trust God? Make God save am naw! If God love am well-well, make E kon diliver am naw!”


Many of dem dey sey, “God nor go save am.”


Dia wahala don break my bones. Dem dey laf dey sey, “Where dat yor God dey sef?”


Dem dey sey, “God don rijet am. So make wi go katch am, bikos nobody go help am again.”


Di offisa kon ansa, “Una tink sey na only di king and una three, di king send mi kom tell all dis tins? No! I still dey tell di pipol wey sidan for di wall, wey go soon chop dia shit kon drink dia piss, just as unasef go do.”


“Make una nor let Hezekaya deceive una sey God go save una. E get any god wey fit save en pipol from Assyria king?


Since e trust God, make God kon save am naw, bikos e sey, ‘I bi God Pikin!’ ”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ