Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kronikles 31:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 Wen dem give di orda, Israel pipol bring dia grain, wine, olive oil, honey and all wetin dem get for dia farm. Dem bring one for evry ten tins wey dem get and dem plenty well-well.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kronikles 31:5
22 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Dat day, dem kon pick men wey go dey guide di store room for di ofrins, di first part for di harvest and one out of evry ten tin wey dem give God. Na dem dey kollect money from di field outside di town and di part wey di law give di priest and Levi pipol. All di pipol for Judah dey happy, bikos of di work wey Levi pipol and di priests dey do.


Den Israel pipol kon start to dey bring one out of evry ten korn, wine and olive oil kom di temple store room again.


I still provide di wood wey dem go use take burn di ofrin for di rite time and for di first korn and fruit. My God, I beg, make Yu remember mi for good and bless mi.


“Make una give mi una plant and wine ofrin. “Una must give mi di first son wey una born.


“Una must bring di first fruit wey una harvest from una farm to di Oga una God house. “Make una nor kook yong goat wey still dey suck en mama breast.”


Una must keep di Week Feast wen una don bigin harvest di first fruit from una farm and di Tanksgivin Feast wen di year don end.


Una must bring di first fruit wey una harvest from una farm kom di Oga una God house. Make una nor kill or chop animal wey still dey suck breast.”


Make una take ofrin kom give God. Make evribody give ofrin from en heart as e fit do; ofrin wey bi gold, silva, bronze,


Honor God with yor money kon offa di first fruit wey yu harvest from yor farm gi-am.


“ ‘One out of evry ten tin for wetin grow for di land, weda na grain or fruit, go bi God own.


“I dey give yu all di best olive oil, wine, wheat and di first fruit wey Israel pipol give God.


And any first fruit wey ripe for dia land wey dem give God, go bi yor own. Evribody wey dey klean for yor family go fit chop am.


God kon tell Aaron, “Si, I don put yu to kare for my special ofrin; I don give yu all di holy tins wey Israel pipol give mi as yu and yor sons own forever.


Di Holy Spirit don make us dey sure of how tumoro go bi. But naw, wi dey struggol as wi dey wait make God show sey wi bi en shidren, den E go kon save us.


But God don raiz Christ from deat! And E make us dey sure sey, oda pipol go raiz-up from deat too.


As God wont am, E kon born us with di true message, so dat wi go bi first among all wetin E kreate.


Dis ones nor spoil demsef with wimen, bikos dem bi virgin. Na dem dey follow di Lamb wen e dey go anywhere. God save dem as human being, so dat dem go bi di first fruit wey en and di Lamb plok.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ