Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kronikles 31:15 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

15 For di town wey priests dey stay, Eden, Mijamin, Jeshua, Shemaya, Amaraya and Shekanaya dey help Kore share di tins give di oda priests akordin to dia work and age.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kronikles 31:15
8 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Just like di leaders for Aaron family, dem divide dia work give dem with dice wey dem trow without sey dem use age or rank. King David, Zadok, Ahimelek, di priests and di leaders for Levi tribe dey der and dem do evritin for dia front.


Dem dey trow dice to take know di work wey dem go do, weda yu old or yong, weda yu sabi di work or just dey start am.


All di men wey guide di gates na 212. Dem register dem akordin to where dem stay. Na King David and Samuel wey bi profet, put dem for dis pozishon.


Dis na Levi pipol wey ready to do wetin di king tok: From Kohat shidren-shidren: wi get Mahat wey bi Amasai pikin and Joel wey bi Zabud pikin. From Merari shidren-shidren: wi get Kish wey bi Abdi pikin and Zabud wey Jehallelel born. From Gershon shidren-shidren: wi get Joah wey bi Zimma pikin and Eden wey Joah born.


Jehiel, Azazaya, Nahat, Asahel, Jerimot, Jozabad, Eliel, Ismakaya, Mahat and Benaya dey work under Kenanaya and en broda Shimei wey bi di oga for God Temple, bikos na so King Hezekaya and Zabud wey bi oga for di temple, wont make e bi.


Imnah pikin Kore, wey kom from Levi tribe, dey guide di east side for di temple and na-im still dey kollect and divide di gifts wey pipol bring kon give God.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ