Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kronikles 30:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Dem nor fit dey do am always, bikos many of di priest neva fit santify diasef and di pipol neva gada for Jerusalem.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kronikles 30:3
8 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Dem start to klean for di first day for di first mont and for di eight day for di mont, dem klean rish di varanda for God Temple. Dem klean God Temple for anoda eight days kon finish for di sixteent day for di same mont.


But dem nor get enough priest to kill all di animals. So, Levi pipol wey bi dia brodas kon help dem till di work finish and di priest santify demsef. Levi pipol even santify demsef pass di priest.


Dem kill di Passova lamb for di fourteent day for di sekond mont. Di priest and Levi pipol kon dey shame for diasef, so dem go God Temple go klean demsef kon offa burnt ofrin.


King Hezekaya give di pipol 1,000 bulls and 7,000 sheep. Di ofisas still give dem 1,000 bulls and 10,000 sheep. Many priest santify diasef too.


Make una kill di Passova lamb, dedikate and prepare unasef for una pipol kon do wetin God kommand una thru Moses.”


For evening for di fourteent day for di first mont, make una chop bread wey nor get yist, until di twenty-first day evening for di same mont.


“ ‘Una must kare for am until di fourteent day for dis mont, den for evening, di whole kommunity for Israel go kill all di animals.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ